Ha ba Oga!
Why u do me like this?
I help u dis ur enemies;
Even help you arrest and rest many down to 6.
And anytime I see u,
Na so me and my boys dey stand like pole till u go.
Ha ba Oga!
Na wetin u ask wen I never do?
Transfer! I dey transfer dem far-far!
Arrange tins! I nor dey fail at all, at all;
U kw say shit nor dey beg to smell;
As u shit na so we dey pack am, sharp-sharp before dem smell am!
Now u wan make I smell out like shit wen den don flush
Shey na shit I go dey chop?
After I don kill one man for Aba road becos of u.
U say u no wan use eye see me again.
Ha ba Oga!
#ogaatthetop #obey #now
No comments:
Post a Comment